Fans React As Neo wash Vee pant For BBNaija – Video

Fans enta social media to debate whether dem fit wash dia partners pant ontop tori say BBNaija housemate Neo wash Vee pant for di show.

On Wednesday night for di laundry room, Nengi shock as she hear say Neo dey wash Vee pant.

Neo and Vee na di only couple wey make am to di top 5 of di Big Brother Naija ‘Lockdown’ reality show afta dem survive last week eviction.

Loading...

For inside video wey dey go viral for social media, Camera show Neo dey wash clothes, while Nengi and Vee dey look am.

Neo Wash Vee Pant Tru Tru

Di mata start wen Vee tell Neo say “My dear, one pant dey miss” di tin surprise Nengi as she first she reserve her comment but later voice out say “Neo, you even wash pant join.”

BBNaija housemate Vee

vee

Loading...

Vee reply her say Neo know say she na clean girl.

Another Tori4TOwn: BBNaija 2020: Dorathy Reveals How She Feels About Ozo

Nengi come tell her say she be very lucky girl.

Loading...

Dis don make plenty fans react. See some of di reactions.

Some even conduct pool for to know weda e good for man to wash him woman pant or not

The Author

RoyalStranger

Blogger ✓ Web Developer ✓Media Consultant ✓ Blockchain/Crypto Enthusiast ✓ Influencer ✓ TECHNOPRENEUR

Leave a Reply